MrBeast: Top ten most subscribed YouTube Channels for di world

Wia dis foto come from, MrBeast
- Author, Liv McMahon
- Role, Technology reporter
MrBeast don overtake T-Series as di biggest YouTube channel inside a long-running battle for di most subscribers.
Indian music label T-Series, wey dey upload trailers and music videos, bin hold di record for di largest YouTube channel for five years, before dem fall comot di table on Sunday.
MrBeast, wey e real name na Jimmy Donaldson, already be di pesin with di largest following.
But di 26-year-old now don make history ontop di platform with ogbonge 269 million subscribers, as e pursue T-Series comot to siddon ontop di table.
Across nearly 800 videos MrBeast don make a name for imself with ogbonge stunts - including giving away private islands, being buried alive, and staging a real-life version of di Netflix hit Squid Game.
End of Di one wey oda users dey read well well
Inside a post on X, MrBeast say e don finally "avenge" YouTube star Felix Kjellberg, wey pipo sabi as PewDiePie, as e pass T-Series' 266m subscriber count.
Inside a follow-up post, MrBeast say im channel take di record with im largest ever daily spike in subscribers, wey rise by more dan 2 million on Saturday.
T-Series originally set di record for 2019.
MrBeast becoming di most subscribed-to individual and channel on YouTube mean say im hold strong im wealth, ontop di platform even further.
E get several oda channels dedicated to im gaming, philanthropy and reactions to oda content - wey account for tens of millions of subscribers each.
"No email me to ask for money, I dey do give away of money because e dey make me happy," na so im channel description tell viewers, referring to di ogbonge amount of cash - in millions - wey e don distribute during im YouTube career.
One video e post for April show as one pesin win $250,000 (£196,000).
For 2022, Forbes estimate im net worth to be around $500m and rank am first on dia list of di 50 top creators for 2023.
Elon Musk, wey don encourage MrBeast and oda video creators to post on im platform X (formerly Twitter), dey among those wey congratulate am.
Making X more appealing platform for creators na a key part of Mr Musk strategy for making di platform profitable, and di YouTuber reveal for January say e earn $250,000 from im first video e post ontop X.
And MrBeast taking di record go come as welcome news for Amazon - wey don sign am to a TV deal wey worth as much as $100m according to reports.
Di top 10 most subscribed YouTube Channels for di world
- MrBeast - 269 million
- T-Series - 266 million
- Cocomelon - 176 million
- Sony Entertainment Television - 173 million
- Kids Diana Show - 122 million
- Vlad and Niki - 118 million
- Like Nastya - 116 million
- PewDiePie - 111 million
- Zee Music Company - 107
- WWE - 102
Who be MrBeast?
Jimmy Donaldson, di pesin di online world sabi as MrBeast, na di biggest YouTuber on di planet – and dat im popularity follow plenty money come.
Di 26-year-old na di highest paid YouTuber for 2022 according to Forbes.
Dem born am for 7 May 1998 for Wichita, Kansas, America.
E start im Youtube channel for 2012 wen e be just 13-year-old. E bin start to dey post stuff like “worst intros” videos wia e go review small children wey get funny or bad intros.
Ova di years, as e begin get more money, e dey use dat money help pipo.
E bin branch out from video-making to do oda tins like get im own fast-food chain but na YouTube e for still dey popular.
Im biggest video till date, wey get 472 million views, na di Netflix hit Squid Game wey e recreate in real life, wey include a $456,000 prize fund.
Donaldson dey popular for im philanthropic work and many business ventures e establish.
E get licensed charity wey dey work as food bank wey e take dey feed communities across di US, and e don help raise raise tens of millions of dollars to help di environment.